Search This Blog

Monday, May 20, 2013

The bells are ringing....

....Alarm bells I mean.

I gotchya didn't I? Ok Maybe not.

That's mostly what I wanted to say - a feeble attempt at playing a prank. It has been long since I last played a prank on anyone. It'd seem I have become overly cautious...

Anyways, na gist I carry come, though reluctantly. So I go knack the tory for pidgin - na so e de do me today. So fast forward to the gist.

Na sense people full this world o. Me believe say, as me be pesin wen no de do cunny-cunny, no be cunny man go bury me! E be like say confusion plenty insai some people head wen dem wan join them wahala with anoda man own. Na so trouble de sleep yanga go wake am. Make una de hear o.

I bin de try hook one of my friends up with one guy wen de wok for my office. The guy try sha, im tall come de coole. No be say I no like better thing o, but as e be for that time, me sef don catch one mugu so I tink am say make me sef try arrange something for my girl.I bin think say na how shall i shy de do the guy so I take style bully am...you know, i fit call my friend just because the bobo waka enter my office con give the guy phone say make im by force tok. Na so so stammer im go de stammer. Trust me, na yabis i go finish am with. I try gaan o. I send picshaw - from one person to the other. No do no do, I connect them for BB. After much much my friend con de complain gimme say the guy just no de try. She gimme some kain gist before I stop to de try myself as matchmaker, I tell am to delete the guy jare. Finally sha, she delete d guy. Na im I organize one function so, both of them jam for dia na im d guy introduce imself to her - i laugh no be small wen i hear d gist con they think for my mind wetin im expect say go shele wen im introduce imself... Wonders shall never end.



Anoda one happen wen facebook join - na me be d busy body wen link the facebook insai the matter. No be say I no like this guy either but true tok be say this my other friend fit d guy pass - she don de de desperate to marry sake of say she be the first girl for her house and her younger sister sef don hook man. So una fit say na charity work i de do, truth fit de insai dat una tok. She sef try. Before the guy gree add her for facebook nko? Na me con de ask am say shey no be human being she be? Na so gist begin o - trust my friend, she knack d matter for head tell my guy say no be small pikin thing she wan do o, say na marry she de so. She con tell the guy how me sef don stamp am say na better person im be and dat her mama sef don look im face for facebook con like am. Make a no too tay for this gist, dem jam for one shopping center for lagos and na for dia d matter begin to end. Na im she con rethink wetin she wan do sake of say she wan marry...hmm! My sharp friend just about turn begin de shuffle the other cards wen she bin get for hand. Wen she tell me say d guy be like say na mago mago im de play, i con tink am kuku tell my friend make she take the matter coole try hear wetin her mind de tell am. Na so d matter don end. Wetin I go tok again? God de and person wen de find sth go meet am.

I de feel for my paddys wen i don give you dem gist so but menh! no be by force eh! No be because I don cross border na im I de yarn like otondo but true tok be say even if person marry imself wahala go still de. no be say make person no de pray say make e happen for am o, but sometimes e better make person de alone instead for to join body with wrong maga. anyways, d oda gist i get na work in progress, maybe e go be my first match making success! If e happen I go gist una.

Muah! Cash ya larer!